A woman who was earlier accused for absconding with a baby in Angwan Rukuba area of Jos Plateau State has given her own side of the story..
According to her, she took the baby to the grandma.
“I took the baby to the grandma”.
As e be, di pikin mama and her husband dey get issues for house wey dey make am come my side time to time. E reach point wey even her clothes and other stuff dey my room because she dey come my room plenty times.
On this fateful day, we bin agree say myself and her (pikin mama) dey travel go meet her mama for where she dey. As we bin dey ready to go, she yarn me say make I kuku go, she go jam me for park. Naso e take happen, I carry her pikin go because as e be, na coded something wey plenty eye no for see, and I wait foram for park.
Rain come dey fall like no man business and the pikin mama bin no dey feel too well lydat. As di rain no gree stop, she come burst my phone say make I just dey go she go meet me and her pikin di next day.
As e be, I no even understand wetin dey really sup because na help me wan help this woman and e turn like so. As she change her mind say she no wan follow me, she for call me say make I return or tell me wetin to do but she come dey tell people say I follow japa with her pikin.
Be like say di husband come dey look for im pikin and she don dey fear wetin go happun because di man get temper wey e suppose try dey control. As she no fit tellam say she wan leave di house, she come use style hang me upside down for cross.
I swear say na true I dey talk and di pikin mama know say na help I offer as per friend wey I be. E get plenty things wey dey involved in the story wey mouth heavy me to talk but I promise say I no get any bad intention. Immediately I get money to ride danfo, I go show face with her pikin.
Credit:Tudunwadabroadcast
Leave a Reply